Ayodeji Ibrahim Balogun (deybon am 16 July 1990) wey pipo sabi wel wel asWizkid naNaija singa an song-raita. Dey bon wizkid for Ojuelegba, Surulere inLegos Stet. Wizkid na one of di singa wey get levu wel wel for Afrobeat muzik. E fit sing afropop, R&B, afrobeat, Regga, dancehall, an pop muzik.
Wizkid don dey sing sins e de 11 year old. E don evun rilis one kolaboreshon with e group wen e still dey smol. Di nem of di group dat time na"Glorious Five". All of dem wey de di group dey go di sem chorch dat time.In 2009, Wizkid sahin ondaBanky W rekod lebelEmpire Mates Entertainment (E.M.E). Na one song wey di tahitu biHolla at your Boy mek wizkid popula wel wel. Dat song bi di fest song for e habom wey e nemSuperstar wey kom out in 2011. Oda muzik wey de inside diSuperstar habom na:"Tease me/Bad Guys", an"Don't Dull"